DISJOINTED TUNES

'dotun
'dotun
Jul 25, 2017 · 2 min read
Source: Google Images

VERSE ONE

Dem tell us make we go school,

Say our life go beta,

Say things no go hard us

Say we go make money — shower am like confetti

We go,

We graduate;

Serve, con dey search for work — no show

Man pikin graduate

Him become statistics — unemeployment statistics

VERSE TWO

Economy dey laugh person pocket

Empty pocket — wetin be bank account sef?

Shebi na person wey get money dey use ATM

Boy learn carpentry work;

Him dey happy for the job at the new building site

Money suppose show after this,

Contractor don bribe government officials

Boy dey ontop building dey join wood for roofwork

Building collapse — substandard materials

Government setup committee of jokers

Court just dey adjourn like say tomorrow no go come

Rubbles — bricks, mortar and metals - bury man.

VERSE THREE

No food, hunger plenty for we land;

Omo boy decide to go yonder — as per life go beta

He no get ticket,

Talk less of visa;

He hide inside tyre compartment of Boeing 737

He no wan follow Libya because of rebels and war

He no wan YAMUTU like Uchendu

Uchendu rubber boat kpeme for sea before dem reach Italy

Plane start to move for runway

The plane tilt for take off

Baba lose him hold, land on top tarmac;

Dunlop slippers, pure water, blood everywhere

VERSE FOUR

Mama dey cry,

Papa just siddon dey look — emotion-less

Dem being get hope say pikin go cancel their poverty

Say their life go soon beta

Poverty kill person, ignorance kpai person;

Man pikin die — government do nothing

Man pikin die — him die for nothing.

END NOTE: I read Omonijo Oluwaseun’s post on Facebook and it help me complete this piece I had tinkering with, in my head. Thanks Shawn, for the inspiration.

Written by

'dotun

Interest includes; Sociology, Advertising, Marketing Research & Reading Biographies. Evolving.

Welcome to a place where words matter. On Medium, smart voices and original ideas take center stage - with no ads in sight. Watch
Follow all the topics you care about, and we’ll deliver the best stories for you to your homepage and inbox. Explore
Get unlimited access to the best stories on Medium — and support writers while you’re at it. Just $5/month. Upgrade