Latest Gele Styles (2019)

AmeboupdateHQ
2 min readJul 9, 2019

--

All dis na de latest gele styles wey dey reign now

Before we go see de latest gele styles wey you fit dey on board, make we talk about dis African fashion style small.

Gele na de local headtie wey women dey wear for special occasions take support “iro” and “buba”.

Latest Ankara Short Gowns For June 2018

To make gele, you go need stong material wey pesin fit use make any shape without wahala. Anytime wey you see any Naija woman dey tie gele, just know say she don dey go one special party.

Gele na for special occasion like traditional wedding, birthday, chieftaincy title and infact for many many celebration.

Dem dey make some gele from “Aso-Oke”.

Aso-oke na thin thread material wey Yoruba pipo dey use hand weave to use make “top-cloth” wey be wetin oyibo dey call “Aso-oke”.

Some pipo dey buy de gele ready made and e go be de style wey dem want na him dem go collect.

Styles wey dem dey use make gele and even tie dem don change as de latest trends wey dey in town dey very different and e dey allow women show their talent. With dis change so many women dey put more focus on their gele pass wetin dem wear sef because dem believe say na dat one be de main koko and na de same way some men no dey play with their show or shirt or even wrist watch.

As de gele dey so, no be only Naija women get am o even though say most stories talk say na from de Yoruba de style start but nowadays e dey spread enter some African countries as Ghana sef get their own and dem dey call am “duku“.

Na women wey come from royal family for Ghana dey wear am and dem dey wear am for festival, naming ceremony and marriage.

South Africa too get de one wey dem dey wear and dem dem call am “doek”. Dem Dey use to cover their head.

See photos via de link;

--

--

AmeboupdateHQ

Ameboupdate.com na your favorite pidgin blog wey dey give you the latest gbedu, tori and news around Africa!