THIS LOVE THING SEF
There’s something about her. What is this feeling?
I’m a thug dammit! Wozdimeaning??
Sleep no dey gree come for night; so so tossing and turning
This na the same girl wey I use mouth call boring
My own don be! Now when I see am, my hear dey beat gbim gbim, full drumming
Hey God, continue to give me strength to dey face my boys for morning.
Ope o! God don butter my bread, complete with jam and honey
She don finally gree for your boy after all my lyrics and money
The last babe shatter my heart, the pieces heap full lorry
I feel say she be the one, and as a baby boy, I no even worry
But e sure me die, I dey carry this one go meet my mummy
Bad bele people, carry go with your running tummy!
Heweee! Bad bele people don dey use immodium!
My heart! My heart! This heartbreak don upgrade to premium!
I no fit cry, na laugh I dey laugh like say I swallow helium
I no fit chop, I no fit sleep, thoughts just full my whole cranium
Choi! Na karma be dis? Na so our deeds dey go come, like pendulum?
I guess I don bite more than the one I fit chew. Na so dem talk for idiom.