Poem: God Answers Prayers

Figured I wrote this in Pidgin English for funsies xD

--

Photo by JÉSHOOTS: https://www.pexels.com/photo/attractive-businessman-busy-clock-3572/

Humans no like work,
Yet if you no hustle, no food for you,
So I go wake up for morning,
I no do early morn,
I get my own time,
Yet Mamma go shout for head,
It is well,
So I dey go wash up,
Go chop small food,
Open my laptop,
Type away my pain,
Fear catch me,
Refresh on repeat,
Yet no engagement,
Shey my work don enter voicemail?
I commot that place dey go sleep,
I forgot wetin I wan do,
I kan wake up next day,
Omo my page dey explode,
Pleti people dey hail me,
Dem dey feel and like and comment my post die,
I smile because I now no say God don answer my prayer.

--

--

Damilola Abiola-Tikare
The Brain is a Noodle

Hi there.I am Damilola Abiola-Tikare and I am a Content Writer who is also a Digital Marketing Diva. Watch this space for more marketing content.